On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

AFCON 2023: Nigeria Go Face Cameroon For Di Round of 16

Di Super Eagles of Nigeria on Saturday go play with Cameroon for di Round of 16 for di Africa Cup of Nations (AFCON) for Cote d’Ivoire.

Di Super Eagles wey finish second for Group A with 7 points go face Cameroon wey still finish second for Group C with 4 points afta dem beat Gambia 3-2 on Tuesday.

Guinea wey bin need draw for dia game with Senegal lose by 2-0 wey make dem come be 3rd with 4 points.

Di Super Eagles enta di round of 16 afta dem beat Guinea Bissau with one alone goal on Monday.

Di last time wey Super Eagles and di Indomitable Lions meet for di same stage for AFCON na for Egypt 2019, and Super Eagles still win 2-1. 

Di big match between Nigeria and Cameroon go happen for di Felix Houphouet Boigny Stadium, Abidjan on Saturday by 8pm. 

How una see di mata?
#chookmouth
 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 32°C | Low: 26°C