On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Abuja Building Collapse: FCTA Don Promise Say Dem Go Punish Di Contractors

Di FCT Administration don promise to punish di contractor wey dey run now becos of di four-storey building wey fall and injure nine labourers on Monday afternoon.

Permanent Secretary, FCT Administration , Adesola Olusade, wey call on Tuesday wen eim go di site of where di building bin fall. He tok say any of di staff wey dem catch wey get hand for di wayo waka of di building go face serious punishment.

As e be say nobodi die for di mata, Olusade tok say him dey disappointed with di pipo wey handle di project becos dem go back for sallah break go dey build afta di project consultant and FCDA don advise dem and give dem notice say make dem stop work.

He still tok say di building fall becos dem no follow di professional advice of di consultant and di administration.

Still on dis mata, di Director Development Control, Mukhtar Galadima bin tok say make dem set up high-powered panel to find wetin cause dis badness and to make sure say dem hold di pipo wey dey responsible for am.

According to Galadima:"Dem bin don dey investigate and dat investigation come show say wen di contractor start di work, dem bin tell am make he stop first and submit for basement becos di topography no dey di design". He still tok say "na becos of di swampy nature of di place na eim make dem ask am to resubmit di design.

Di contractor no hear, him still go back di site during di sallah break and one of di worker bin dey try to cast on top di structure wey first dey wen di building fall".

How una see di mata?
#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C