On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

9th Assembly: VP Shettima Bin Host APC, PDP And YP Senators

Vice Presido wey bi Kashim Shettima don ask di former federal legislators say make dem support di Tinubu administration, e still tok say di administration really get di interest to change di country for mind.

E tok dis mata on Wednesday wen e bin organize one meeting wey all di former colleagues from di 9th Senate for di Presidential Villa for Abuja gather together.

VP Shettima kon still tok say e don form lasting rellationship  wit eim colleagues for di last four years wey dem bin dey together.E say eim  believe say di relationship wey e don get wit dem don get go last for a very long time.

Di  leader of di delegation wey bi Senator Philip Aduda tok say di main reason wey dem do dis meeting na for di betterment of di country  

E kon still ask for di support of di APC, PDP, and YPP senators for di Tinubu administration and E kon pray for di success of  di administration say di plans and purpose wey dem get for di country go com out wella .


For di meeting Senators Sam Egwu, Aliyu Abdullahi, Gabriel Suswam, Emmanuel Bwacha, Uche Ekwunife, Stella Oduah, Biodun Olujimi, Hezekiah Dimka, and others bin dey dere. 

How una see dis mata???
#Chookmouth


 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 25°C