On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

12m Families go Get N8,000 for Six Months-President Tinubu

President Bola Tinubu don announce say di Federal Government plan to provide financial help to 12 million low-income families for Nigeria for six months.

Dis informte bin dey di letter wey Senate President Godswil Akpabio wen dem dey siddon discuss on Thursday, wey e ask di 10th Senate to gree for di $800 million moni wey dem wan borrow.

Some part of di letter tok say, "di federal government of Nigeria go transfer N8,000 per month to 12 million poor and low income families for 6 months, that one go reach about 60 million individuals. 

"To make sure say mago mago no dey di mata, na online transfers dem go use take send di moni to dia accounts.

"Dis programme suppose help improve nutrition, bodi mata, education amd human capital of di families wey dem help.

Make we remember say wen Buhari administration dey end, he bin send request for $800 million loan to fund one social safety net program.

E no quick di 9th assembly to look di request before him tenure end for June 11.

How una see di mata?
#chookmouth 

 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C