On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

Police No Fit Arrest Person Wey Use Stream Farm - Mr. Eazi

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

With one of the biggest songs wey dey social media right now, wey be "Patek" Mr Eazi, don ready to show una say una neva see anything at all. As eim don drop anoda one wey eim call See Something.

The Banku music creator and founder of emPawa Africa, enta our ChookMouthStudio to follow Cheche Smith tok on top her show Oga Madam Office Show.

Mr Eazi yarn say eim know say Patek go be hit wen eim do video online and many pipu wey neva follow am yarn for like three months come dey call am say dem wan jump ontop the song.

Cheche ask Eazi based on say eim no just be artiste, eim still be music executive for the business. Wetin eim think about the mata of stream farm wey trend for online some weeks ago.

Eim tok say eim feel anybody wey dey use stream farm dey do ojoro to the answer, but e no be crime because police no fit arrest person wey dey use stream farm dey push dia music. 

As eim take tok am "if you dey inside the market, and the market get rule book for inside. If nobody dey follow am, e mean say the rules wey the market dey follow na rules wey the market dey create"

Eim come still yarn say one person fit see streaming farm like marketing tool to take push dia music, while other people fit use google advert and social media influencers to do dia own promotion.

The new single wey be "See Something" get Shatta Wale, DJ Neptune, Medikal & Minz inside. Cheche ask am how eim take get everibodi ontop the jam. 

Eazi tok say eim being no plan to put plenti people inside the song, the only person wey eim been wan get ontop the song na just Medikal, but when eim come record am eim see Shatta wale with am and like that Shatta jump enter the music. As eim send the recording to Minz wey be Empawa artist to listen, na so him create space too chook mouth for the song plus DJ Neptune wey eim tell to help am do arrangement for the song.

The Empawa boss still tok some the plans wey eim get for this decemba, eim say "Detty Rave Festival go dey happen for Accra Ghana, on the 27th i no book any artist just DJ's and i go be the hype man for the day."


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 34°C | Low: 28°C