Police No Fit Arrest Person Wey Use Stream Farm - Mr. Eazi

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

With one of the biggest songs wey dey social media right now, wey be "Patek" Mr Eazi, don ready to show una say una neva see anything at all. As eim don drop anoda one wey eim call See Something.

The Banku music creator and founder of emPawa Africa, enta our ChookMouthStudio to follow Cheche Smith tok on top her show Oga Madam Office Show.

Mr Eazi yarn say eim know say Patek go be hit wen eim do video online and many pipu wey neva follow am yarn for like three months come dey call am say dem wan jump ontop the song.

Cheche ask Eazi based on say eim no just be artiste, eim still be music executive for the business. Wetin eim think about the mata of stream farm wey trend for online some weeks ago.

Eim tok say eim feel anybody wey dey use stream farm dey do ojoro to the answer, but e no be crime because police no fit arrest person wey dey use stream farm dey push dia music. 

As eim take tok am "if you dey inside the market, and the market get rule book for inside. If nobody dey follow am, e mean say the rules wey the market dey follow na rules wey the market dey create"

Eim come still yarn say one person fit see streaming farm like marketing tool to take push dia music, while other people fit use google advert and social media influencers to do dia own promotion.

The new single wey be "See Something" get Shatta Wale, DJ Neptune, Medikal & Minz inside. Cheche ask am how eim take get everibodi ontop the jam. 

Eazi tok say eim being no plan to put plenti people inside the song, the only person wey eim been wan get ontop the song na just Medikal, but when eim come record am eim see Shatta wale with am and like that Shatta jump enter the music. As eim send the recording to Minz wey be Empawa artist to listen, na so him create space too chook mouth for the song plus DJ Neptune wey eim tell to help am do arrangement for the song.

The Empawa boss still tok some the plans wey eim get for this decemba, eim say "Detty Rave Festival go dey happen for Accra Ghana, on the 27th i no book any artist just DJ's and i go be the hype man for the day."

More from Oga Madam Office

  • Divorce Palava: Woman Want Husband to Swear for Shrine, Because Of Dia Property

    Video

    Love sweet but sometimes love dey change taste, and dey bitter for the pipu wey dey enjoy am. Wetin dey come spoil belle pass na wey you see two pipu wey love dem self come dey do like say the other person na dia enemy.

  • E take Yemi Alade 5 Years To Reply My DM - GUCHI

    Video

    Ugochi Lydia Onuoha, wey many pipu know as Guchi na Nigerian Afropop/ Afrobeat singer. And she be one of the young female artiste wey dey show say dem no come play for the music industry.

  • Why Naija Men No Dey Like Bring Dia Wife Abroad?

    Video

    Ontop #OgaMadamOfficeShow Cheche Smith tok about the tori of man wey tok say e beta wey your wife dey cheat on you for Naija than for you to carry am come abroad and she comes dey mess your life up.

  • The Music Industry For Ghana No Dey Invest Like Naija - CAMIDOH

    Video

    Raphael Camidoh Kofi Attachie, Ghanaian Afropop, R&B and Afrobeats songwriter and musician. Enta we #ChookMouthStudio to tok about eim new jam wey eim collabo with Mavin records Nigerian born singer and songwriter, Alexander Adelabu wey pipu know as Magixx.

  • Your Pastor No Be Psychologist!

    Video

    On 10th October, the world join bodi togeda to mark world mental health day. And this one na day wey the world dey come to shine light ontop the mata of mental health and why e dey important for everi bodi to take am serious.


Abuja Weather

  • Abuja

    Heavy Rain

    High: 27°C | Low: 21°C