Remember Who Carry You From Gutter Enta Chairmo Chair - Nyesom Wike Tell Iyorchia Ayu

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

River state governor, Nyesom Wike don vex for Di national chairman of di people democratic party (PDP), Iyorchia Ayu because eim call dem pikin for de party.

The governor wey go opening ceremony for omerelu internal roads project wey dey Ikwerre local government area of the state. Yarn say de chairmo fit call dem pikin, but na dem carry am out from gutter come become chairman.

Oga Wike still tok say make de PDP chairmo remember say dem impeach am when eim  be senate presido, and when eim work For former presido Obasanjo dem still commot am for work.

So make oga Ayu calm down because gragra no go help eim matter at all.

Also former chairmo of de People Democratic Party (PDP) Chief Boda George yarn say wetin the chairmo talk no make sense at all. And eim need to watch wetin eim dey yarn.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C