On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

NDLEA Wan Do Drug Test For NYSC Members

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

The chairmo/Cheif Executive Of National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA), wey be Brig-Gen. Mohamad Buba Marwa(Rtd), don dey yarn say dem for NDLEA wan do drug test for National Youth Service Corp(NYSC) members.

Eim say e go good oo make NYSC member do drug test wen dem come camp for dia one year service, because e go follow help the ginger wey NDLEA dey ginger to stop the way highness drug don spread leg siddon berekete inside obodo naija.

Oga Marwa tok this one when The Director General of the NYSC, Brig.-Gen. Mohammed Fadah, come eim office NDLEA headquarters for Abuja.
 


Today's Weather

  • Lagos

    Medium-level cloud

    High: 34°C | Low: 27°C