On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

Lagos State don tok say dem no go take am easy wit Developers of Bad Buildings.

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

The Lagos state government tok say, e no go take am easy wit any Developer or Builder wey eim building fall and put pipu life for danger.

The state Commissioner for Information wey be Gbenga Omotosho tok dis one on Monday for our sista station, The Newsroom.

Him tok say e pain government about building wey collapse on Sunday for Oniru wey pipu even die ontop sef and dem go make sure say pipu wey get hand inside go face di law.

Him also yarn say, the state government dey do evritin to make sure dem fit catch all des Developers/Builders once dem see dem and punish dem too. 

But for now, the Lagos State Police Command say dem neva fit arrest anybody becos of the building wey collapse.

The Police Public Relations Officer wey be Benjamin Hundeyin tell our Sista station say, dem neva sure if di case na criminal one sake of say, dem still dey chook eyes inside di matter. 

The seven-storey building wey dem still dey build, fall on Sunday and na six pipu die.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 34°C | Low: 28°C