On Air Now

Kulele Zone

3:15pm - 6:00pm

KIDNAPPING: Police Go Shine Dia Eye Ontop Mata Of InSecurity For Lagos-Ibadan highway

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

The Inspector-General of Police, IGP Usman Alkali Baba, don hold hand for ear tell eim men say time don reach for dem to shine dia eye for security mata for Lagos-Ibadan expressway. As gbege pipu wen come open kidnapping shop for dia.


Oga Alkali Baba tell eim police men say dem go need change some things ontop how dem dey take do dia work for the area, so that pipu wey dey live for that area and pipu wey dey pass the road go dey safe and mata of kidnapping go stop one time for dia. Even if na to put more police pipu for the area.

Police tok tok pesin CSP Muyiwa Adejobi, yarn say this one wey oga of police tok show say police no just troway face ontop all the bad things wey gbege pipu dey do for that area. Naim make Oga Police don tok to the Commissioners of Police wey dey in charge of Lagos, Ogun, and Oyo State Commands on top the mata, so that dem go fit commot all the gbege pipu wey dey the area.

The IGP still nack hand for chest tok say everi-everi wey dem go need to make sure say the wahala of kidnapping and tiff-tiff go stop for the area eim go make sure say dem get am. So that wen people dey pass the area dem no go dey carry fear for mind.

Dem come still tell Naija pipu wey dey use the road, hunters, community leaders, and pipu wey live for the area. Make dem let police know if dem see or know any gbege pesin and the place wey dem dey stay do dia gbege waka.
 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 34°C | Low: 28°C