On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Dem Don Rescue Seven Pipo From Di Fire Wey Burn Inside WAEC Headquarter For Lagos.

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?
WAEC Headquarter For Lagos Catch Fire.

Di Lagos State Ambulance Service aka LASAMBUS tok say dem don save seven pipo dis early momo for di fire palava wey happen for WAEC headquater wey dey for Jibowu area.

According to di tori wey di Acting Director for di service,Beatrice Makinde yarn give Nigeria Info,eim say dem don successfully quench di fire wit di 
help of Lagos State Fire Service .

She follow tok say di pipo wey dem save from di fire don dey di health center wey dey inside WAEC compound to recieve treatment becos of the burn burn wey dem get .

Di Lagos State Emergency Management Agency aka LASEMA don tok say according to dia investigation say na power surge wey stat from di third floor of di building na eim cause di whole katakata.

 

How U See Di Mata? #chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 34°C | Low: 27°C