Court Don Order Asuu to Call Off Strike

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

National Industrial Court don order Academic Staff Union of Universities make dem go back to work.

Justice Polycarp Hamman tok on Wednesday, say he don invokeSection 18 of Trade Dispute Act, wey allow court to order an end to strike when national interest dey at stake.

Justice Hamman yarn say dem must end the strike sake of say the students have a right to education

Minister of labour and employment on behalf of Federal Government file di mata before court to stop di strike.

Justice Hamman orda say make dem return di case to di president of di Industrial Court make dem give am to anoda Judge.

How u see di mata? #Chookmouth for comment section


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C