On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

CBN Wan Change Di Naira Note Dem By December

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?
CBN Wan Change Naira Note

Di Central Bank for Nigeria aka CBN don tok say dem go release di new N200, N500,and N1000 note dem by December 15,2022.

Oga for CBN wey be Godwin Emefiele na eim tok dis one for inside one special press meeting wey happen for in Abuja on Wednesday.

Di CBN Governor come tok say CBN don record plenty mata wey involve fake naira note especially di N500 and N1000 note dem.

Him say according to di standard dem suppose to dey change di note dem every five to eight years but dem never change di naira note for di past 20 years.

Emefiele come finally tok say by January 31,2023 di old note dem no go dey useful for inside di country again.

 

How U See Di Mata? #chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C