On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

ASUU Strike: NANS Dey Tell Presido Buhari No Siddon Look

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

The National Association of Nigerian Students (NANS) don tell oga Presido Muhammadu Buhari say e come dey be like water go soon pass garri ontop the way this strike mata dey go. So dem want make oga Buhari chook mouth to solve the mata so that students go fit go school back.

The new presido of NANS, Mr Usman Barambu na eim yarn this one on Monday for Abuja for siddon tok wey dem do with news tori pipu.

Barambu yarns say the mata of ASUU strike don dey happen now for 7months, and e don affect the school calendar of Public University.

" This Strike don make student wey suppose go school for 4 years dey stay for 6 years now. And e dey delay university student future."


Chairman of the Communique Drafting Committee, Usman Ayuba even chook mouth for the mata, as eim yarn say make presido Buhari also find people wey sabi work wella and wey fit find answer to the wahala of insecurity for we countri

Ayuba also yarm say make the Ministry of Education ginger for the work wey dem dey do so that our education sector go reach the standard wey UNESCO set for developing countries. 

Eim still tok say students dem want make lectures wey chook hand for the mata of Touch lighting for Good Mark, make dem stop that kind thing because students open dia mata if dem catch dem.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C