ASUU Don finally Suspend Di 8Month Strike For University

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?
ASUU Don Suspend Strike

The Oga for ASUU wey be Professor Emmanuel Sodeke don annouce am on Friday morning say them don hold brake ontop the strike matter.

The Oga for ASUU wey be Professor Emmanuel Sodeke na eim annouce am on Friday morning say them don hold brake ontop the strike matter.
Him tok say this one happen after the big toktok person for National Assembly,Femi Gbajabiamila bin chook plenty mouth inside the matter of the strike wit di union.
 
The Chairman for ASUU say even as Presido Muhammadu Buhari and other better Naija pipo bin don chook mouth ,say dem and di National Executive Council don settle di strike matter wey begin trek from February 14,2022 but this matter never really clear as the federal government never fully settle the demand of lecturer dem.


All the members for ASUU go resume dia duty today Friday,October 14,2022.

 

How U See Di Matter ? #chookmouth 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C