On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

ASUU Dey Reason To End 8 Month Strike

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?
President of di Academic Staff Union of Universities (ASUU), Prof. Emmanuel Osodeke, tok say dem go soon call off dia eight-month-old strike.

President of di Academic Staff Union of Universities (ASUU), Prof. Emmanuel Osodeke, tok say dem go soon call off dia eight-month-old strike.

Osodeke tok for meeting with di oga of the House of Representatives on Monday  for Abuja.

He say from wetin di union see for di meeting  say “light dey at di end of di tunnel"

“Osodeke tok say dem hope say in some days time strike go end.

“He say dem want system where salary go dey plenti enough to bring lecturers evrery where for di world to Nigeria universities. 

He say dem suppose pay Nigerian universities in obodo oyinbo currency so e go attract foreign students, he tok dis one sake of say good lecturers dey leave di kontri.

He say di strike no suppose last two weeks, “if National Assembly don do something before  now”.

Speaker of the House of Reps, Rep. Femi Gbajabiamila, say dem go tell us presido decision on Oct. 11.

 

How u see di mata? #chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 34°C | Low: 27°C