On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - 10:30pm

Victor Osimhen injury update vs Liverpool

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Di Napoli striker don confirm with Wazobia FM sports journalist Buchi Laba say wetin do am no too serious. Buchi tweet last night, say Osimhen bin commot to avoid any risk, no be say eim bin carry serious injury.

Napoli on Wednesday night bin kpokpo Liverpool 4 goals to 1 for inside di Diego Maradona stadium. 

During di match, just before half-time, Napoli manager bin sub Victor Osimhen as wetin oyinbo dey call muscle strain bin happen for eim right leg.

Victor Osimhen di Super Eagles forward before eim commot bin give Liverpool serious wahala, left, right and centre as him knack bar not even up to 1 minute after kick off and eim win penalty over Van Dijk wey Allison save. Small thing remain, eim for don get assist as Kvaratskhelia no bin fit convert di sweet pass wey Osimhen square give am.

Di latest news be say Osimhen no go play Spezia dis weekend as dis na precautionary steps di club dey take to make sure say di player recover fully.

 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C