On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

Great weekend for Nigerian football teams for continental football

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

All di four teams wey dey represent naija for CAF Champions League and CAF Confederations Cup bin impress as dem no lose any match last weekend.

Rivers United wey dey on streak of 17 straight home wins bin make am 18 as dem kpakuka di Liberian side Watanga 3-0 for di first round of CAF Champions League. Di second leg go shele dis Sunday, di 18th of September.

Plateau United wey finish second for NPFL last season, draw 2-2 against Stade Mandji for di Champions League.

For inside CAF Confederations Cup, Kwara United for dormot, keep clean sheet and score AS Douanes from Senegal three goals for di first leg of di first round of di tournament. Kwara United go travel go Dakar, di capital city of Senegal dis Sunday for di second leg. 

Again, for dis level, Remo Stars draw 1-1 agaisnts FAR Rabat for Morocco. Dis one mean say dem go enter di second leg dis Sunday with morale onto say na for dia own dormot di match go happen.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C