Your Pastor No Be Psychologist!

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

On 10th October, the world join bodi togeda to mark world mental health day. And this one na day wey the world dey come to shine light ontop the mata of mental health and why e dey important for everi bodi to take am serious.


On top radio, the midday show for Wazobia Fm. Oga Madam Office invite sabi person for the mata Pamela Udoka, wey be licensed Clinical Psychologist & Therapist.

Dem tok about wetin mental health be and wetin dey happen to people dey dia mental health no good, plus how the environment dey follow spoil pipu mental health.

Udoka yarn say even though she dey religious, but prayer no be the way to save person wey dey suffer from mental health issues. And she come dey warn Naija pipu say dia spiritual leaders no be mental health sabi pipu no make dey no go meet dia pastor or Iman wen dem dey go through mental health problem.

Oya watch the video to see everi-everi wey dem tok ontop the mata.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 43°C | Low: 26°C