Without Money You No Fit Make Am As Artist- King Joel

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Fast rising artist and producer, king Joel. Enta we studio to tok about eim music and how the journey for inside the music waka dey go.

King Joel wey dey based for Atlanta, and eim be founder/CEO of Elision Records. tok about how hard e dey to work with artist for inside the music industry.

Eim say now eim wan sign any young  artrist eim no dey look if dem get talent alone, but eim dey check if them ready to do the work, and if them dey loyal. Because loyalty dey very important to am.

Wen Che Che ask King Joel If Eim Don eva look the music waka, come tell eim self say e do tire me. Joel answer say music business dey get up and down side, wey dey make am hard sometimes. Eim even come tok say plenty fake pipu full for inside the industry.

King Joel come advise young artist say if you no get money and you no get anybody wey dey support your hustle. you go sing tire ooo.

eim come tok say for him no be just to dey sing alone na eim him dey do oo, eim dey also use the blessing wey eim get dey touch other pipu life. as during #EndSars protest eim use up to 30 million take supporting the waka. And e neva tey wey eim arrange debate competition for children wey eim tell dem to tok about how dem fit  make Nigeria beta.

Before eim waka commot for our studio, Che Che ask am bout wetin make eim fans dey expect from am untop music. King Joel tok say eim just work with one of the biggest artist inside obodo africa wey be Davido. So make dem dey expect.

 

 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 21°C