Why Una No See My Drama For Inside Big Brother House - Christy O

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

The drama for inside the Big Brother Naija season 7 house don dey turn up. As last weekend Big Brother tell three house mate make dem carry dia kaya commot from eim house.

Out of the 3 house mate one of them wey be Beauty Tukura, choppulate dissqualification because of the way wey she behave for inside Biggie house,  she stone her wig and glasses for Groovy body afta dia Saturday Night Party. She collect Double Strike from Biggie for her actions.

The other two housemates wey commot for the first eviction show of di Big Brother Naija Season 7 level Up show. Na Christiana Oluwafunke Ojumu alias Christy O and Cyph real name na Bright Hidi Nwekete.

Dia two enta #OgaMadamOfficeShow with Cheche Smith to tok about how dia waka for inside Big brother house go.

Christy O wey promise viewers say make dem dey expect beta drama for her hand inside the house, explain to Cheche wey she no come fit give the viewers wetin she promise.

According to her she been dey suffer from skin reaction since she dey lockdown for she enta the house, and the reaction continue to disturb her after she enter. Naim make she come beg Biggie for medicine to help her copy with the reaction.

So na the medicine wey she dey take make her no fit show her colour inside Biggie house.

Cyph tell Cheche how one of the housemate wey dey inside the other house catch eim eye. 

oya watch the full siddon talk to see all the koko make them yarn Cheche.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 20°C