Wetin you suppose know about Hepatitis-B and how to prevent am.

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Research don show say plenty people inside we obodo naija, dey suffer from Hepatitis and dem no even know say dem get am.

Hepatitis-B na disease wey fit waka from one person enta another person. and wetin dey bad for this disease na say e fit dey person body and the person no go know, until e don dey too late.

Because this disease dey affect plenty people and dem fit no know, na eim make che che siddon talk to body mata person,Dr. Esther Adelopo wey be Head of Clinic, Medcenter. so that dem go fit help people know wetin this Hepatitis-B, wetin be the symptoms and how people fit take prevent to get this disease.

Dr.Adelopo even talk say "Hepatitis-B dey waka wella from person to person, pass HIV" and the way wey person fit get am if you dey share razor, shaving stick with other people and  mama fit give am to eim new born baby. person fit get even through blood transfusion and other ways too.

watch the interview as she take talk am.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 20°C