I Name My Album Boy Alone After My Papa - Omah Lay

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

After eim drop two banger EP's ( #GetLayd and #WhatHaveWeDone) inside 2020, Omah Stanley Didia wey we all known as Omah Lay enta we Wazobia Fm studio to follow us yarn about eim first ever album wey eim just drop.

The album wey the title na #BoyAlone drop on Friday 15th July 2022, and plenti people wey don listen to the album don dey clap hand for the artiste say eim no disappoint at all.

For inside the siddon tok wey eim get with Wazobia Fm toktok person Cheche Smith, for #OgamadamOfficeShow. Eim tok about wetin inspire the project title. According to am eim say "Boy Alone" na my papa nick name, pipu being dey call am dat name because of eim hustle spirit, but me no too like the name when i small but now wey i don old, i fit relate with am that na why i name my  album #BoyAlone.

The album drop wen Omah Lay dey on eim global tour after eim drop one of eim biggest collabo wey get american popstar Justin Bieber inside. All this one really stress am because as eim dey travel from place to place na so with they enta studio go record sef. According to wetin eim yarn "The process of making the album no easy for me, to the extent i enta depression wey wan carry me enta the level of sucide sef,  wey make me even go see therapist.                                                                   

But the stress never make am stop work even now the album #BoyAlone don land, because wen dem ask am about the collabo wey make eim fans dey expect from am. Omah Lay yarn say " My EP him and Bella Shmurda dey work on togeda don ready na just make dem just put fullstop and comma remain.  Me and Burna Boy get something so dey expect am. 

Watch the full siddon tok with Cheche for the video wey dey this story.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 21°C