I Feel like I be the most hated man for Africa - Boma

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

The housemates wey dem evict commot for the big brother house, enta we studio to follow Cheche talk about how their waka go inside the house.

The evicted housemate wey be Boma Akpore, Peace Ogor, Tega Offiong Dominic, and Michael Chukwuebuka Ngene. tell Cheche on top Oga Madam Office show,  wetin dem see inside the house, the stategy wey dem carry for mind take enta the house plus the people wey dem be get eye for inside the house.

Boma,  talk about how eim don dey get death treat, because of the gum body wey eim do with tega for inside the house, plus how all the reaction take affect him and eim team wey dey handle eim publicity.

Tega too also talk about how she dey handle the way wey pipu take react, to the gum body with Boma, and when Che Che ask her if she don follow her husband yarn, she say yes and dem dey okay.

Michael wey be one the housemates wey win plenty money pass for the inside the house, talk about wetin dey go on between him and Jackie-B inside the house, and how eim go like to follow up with the level outside big brother house.

You fit get the full gist, wen you watch the interview. No forget to tell us wetin you think for comment section.

 

 

 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 20°C