Yunusa Tanko Talk Say Some People Betray Am for Obidient Movement, Claim Say Dem Force Am Comot

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Former National Coordinator of Obidient Movement, Yunusa Tanko, don accuse some members of the group of betraying the trust and loyalty wey e get for dem. E say na dem force am comot, no be say na im willingly decide to leave.

Tanko make dis revelation while e dey speak with journalists, after dem appoint am as National Coordinator of Social Democratic Party (SDP) Presidential Campaign Council ahead of 2027 general elections.

E talk say e appreciate former Anambra State Governor, Peter Obi, for giving am the opportunity to serve, but e no fit know wetin the politician dey think about im departure from the movement.

Tanko talk say:

“For Peter Obi matter, e different. You no fit talk wetin dey im mind. Na only im fit talk wetin dey im mind.”

E add say:

“As far as I dey concerned, I appreciate all the work wey I don do, and I appreciate am for giving me the opportunity.”

But Tanko say betrayal na wetin e experience while e dey inside the movement.

E talk say:

“The only thing wey I suffer for that movement na betrayal of trust and loyalty. Na people wey recognise the little effort wey I contribute towards building the nation pick me up and turn me to diamond.”

Tanko also insist say no be say na im willingly leave the movement.

E talk say:

“I no comot from the movement by myself. Na dem comot me. So, if dem don comot me, I no go remain where dem dey only tolerate me. I go where dem dey appreciate me.”

Peter Obi appoint Tanko as National Coordinator of Obidient Movement for September 2024.

Dem remove am from the position for October 2026 and later appoint am as Political Adviser for Northern Nigeria.

Tanko resign from the advisory position on October 30 before e join SDP campaign team, where e go coordinate the presidential campaign of Prince Adewole Adebayo.

Obidient Movement don since wish am success for im new political assignment.

Comments

Add a comment

Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 14°C