When Queen Visit Nigeria for 1956

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

In 1956, better crowd inside Lagos, Nigeria welcome Queen Elizabeth II.

That na four years before Nigeria’s independence.

Di queen’s visit come with plenti plenti party.

Inside pipu wey come welcome her na Federal Minister of Labour and Welfare, Chief Festus Okotie Eboh.

Lagos traditional leaders like Chief Adeniji Adele II also join welcome her

She meet many chiefs during her 20-day visit wey start on 28 January and end on 16 February.

Na garden party inside Lagos naim dey take host the queen.

Inside Federal House of Representatives, the queen, wey her husband wey be di Duke of Edinburgh, receive pledge of loyalty on behalf of her then Nigerian subjects.

Speaking inside the House the queen tok say, “Me and my husband dey really happy as una welcome us, na God go bless you.

Lawyers also gada dey with the queen. This one happen inside one formal ceremony, wey dem hold to inaugurate the new federal court inside Lagos.

Queen Elizabeth no dey only inside Lagos State.

She also enta inside Kaduna State where beta crowd of horsemen and leaders of different tribes and different areas inside Northern Nigeria.

The area leaders come from Ilorin, Kabba, Benue, Niger, Zaria, Katsina, Adamawa, Bauchi, Kano, Borno, Sokoto, and Plateau. 

Dem use different dance wey different tribes dance as dem wear dia traditional costumes and attires.

She even enta Port Harcourt but her final busstop inside Nigeria na di ancient city of Kano where pipu travel come see her.

For di end, na better visit wey make sense for the queen and Naija pipu.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 43°C | Low: 22°C