Wetin You Need To Know About The New Student Loan Law

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

15 Days after President Bola Ahmed Tinubu Siddon for chair a presido, eim don carry biro(pen) take sign say Nigeria students go fit get loan wey no get interest on top for dem to fit pay dia school fees for university.


The wey na former Speaker, Femi Gbajabiamila naim introduce am for the 9th National Assembly around 2016, and eim call am "Bill for an Act to Provide for Easy Access to Higher Education for Nigerians Through Interest-free Loans from the Nigerian Education Bank".

Na this year the House of Representatives come agree with the bill.

The bill tok say dem go create the Nigerian Education Bank, wey go chook eye on top the student loan mata for Nigeria. 

Na for the bank, naim student go fit to submit dia application for the loan. And dem go make sure say the student's wey collect the loan go fit pay back the loan.

For the bill dem tok say all student wey wan go school for inside any government university naim go fit to go collect the loan.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 44°C | Low: 25°C