We Go Still Dey Use Old Naira Note For Lagos - Governor Sanwo-Olu

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, don tell business pipo wey dey sell market say, make dem dey collect di old N500 and N1,000 as we go still dey use am for Lagos.

Governor Sanwo-Olu for one report wey him give di State’s Commissioner for Information & Strategy, Gbenga Omotosho, he tok say, him know say dis Naira wey dem redesign dey cause wahala and e dey really disturb business pipo and other important things. 

Di thing wey dem write put for di report na say: “We no get any reason to tok say we no go collect di old moni, as Supreme Court don tok say make we dey use am since March 3, 2023''.

"Di Oga patapata of di whole court for Nigeria tok say, 'CBN no give proper notice as deir Section 20(3) for deir CBN Act tok,' say na media pipo and news pipo na im make di whole public know deir plans, and we no fit call dis one public notice.''

As di governor tok, di court tok say dis new moni wahala don make am hard for dem to do deir work as State governments, and because of dis one, di order to stop to dey use di old moni dey illegal, unofficial, invalid and cancelled.

Sanwo-Olu, still tok say, he dey advise all agencies of Lagos State Government say make dem no reject any payment wey pipo won pay with di old moni until December 31, 2023, wey be di deadline wey di Oga patapata of all di Courts for Nigeria tok.

#chookmouth
 

 

 

 

 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 20°C