We Go Chook Eye Ontop The Seven-Story Wey Fall For Inside Banana Island - Lagos State Gov

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Ontop the mata of the seven-storey building wey fall yakata inside Banana Island, wey dey for Ikoyi area of Lagos state. 

The state government don talk say don arrange dia eyeglass plus torchlight to take chook eye ontop the build mata.

Lagos State Ministry of Physical Planning and Urban Development wey tell tori pipu say yes oo the mata happen, and some workers wey dey the site been injure and dem dey collect treatment but so far nobody don die because of the collapse.

The Deputy Director of the Ministry, Public Affairs, Mukaila Sanusi. still yarn say dem go do dia best to find out wetin happen to the building.

Dem still tell pipu wey dem no fear, as the state government dem dey ontop the mata.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 42°C | Low: 25°C