On Air Now

Evening Oyoyo

8:00pm - Midnight

Veteran Actress Ngozi Nwosu Dey Beg for ₦30 Million Support for Surgery From Hospital Bed

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Veteran Nollywood actress Ngozi Nwosu don beg Nigerians make dem support am with money to raise ₦30 million for three emergency surgeries wey fit save her life, after she don spend three weeks for hospital.

Veteran actress Ngozi Nwosu make the emotional appeal for one video wey she post for her Instagram page on Thursday. She talk say her health condition don bad pass wetin she and her family fit handle

"My people, my fans and my family, I know say una never see me for public since. I don dey hospital for three weeks now. Abeg, dis matter don pass my power," Nwosu tok.

With tears for her eye, Nwosu beg her fans and supporters make dem no abandon her for dis hard period of her life."I need una help. Abeg, no let me die. I know say una no dey ever forsake me. I dey beg una, my fans and family, no let me die because I dey go through plenty pain," she tok.

Di actress also reveal say she need three surgeries, and she beg anybody wey wan support her treatment make dem contact her management."Abeg, no let me die. If you wan do anything for me, abeg contact my management. Dem go attend to una. Thank you.God bless una," she tok.

For the message wey she attach to the video, Nwosu talk say e no easy for her to come outside come ask for help, but the urgency of her condition leave her with no choice. "My fans, friends, family and colleagues, e really hard for me to do this, but I no fit keep quiet again. I need urgent surgeries wey go save my life. Abeg no just scroll pass. Share this post and support me if you fit," she write.

She talk say the total money wey the three surgeries go cost na ₦30 million, and she pray for everybody wey go support her. "God bless una, and make you and your family never experience this kind suffering."

Comments

Add a comment

Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 36°C | Low: 23°C