Uyo, Nigeria to host 2022 TotalEnergies Confederation Cup final

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

The Confederation for African Football, CAF don talk say the Godswill Akpabio International Stadium for Uyo, Nigeria go host the 2021/22 TotalEnergies Confederation Cup final on Friday, 20 May 2022.

CAF still tok say, dem go soon yarn the time wey the match go start.

This na the first time wey dem go play major intercontinental cup final for Uyo. Uyo na the capital of Akwa Ibom State and na dia wey Akwa United dey play their matches.

Last year wey be 2021, na Cotonou, Benin wey host the TotalEnergies Confederation Cup final and for the match, Raja Club Athletic beat Algerian side, JS Kabylie 2-1.

Na four teams remain for the race to win the 2021/22 TotalEnergies CAF Confederation Cup. 

For the first match for the first leg of semi-finals, TP Mazembe knack RS Berkane of Morroco 1-0.

For the second semi-final, hand bin touch Al Ahli Tripoli as Orlando Pirates beat dem 2-0.

Na on Sunday, May 15, 2022 dem go play the second leg.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 20°C