Tinubu Don Appoint Eight Special Advisers

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

President Bola Tinubu don appoint eight special advisers

Na di State House Director of Information,Abiodun Oladunjoye release di list of advisers on Thursday afta one National Executive Council meeting.

Dis list get Dele Alake wey dem appoint as di Special Adviser on Special duties, Communications and Strategy;Wale Edun go advise Presido on Monetary Policy mata; and Nuhu Ribadu go be Special Adviser on Security .

Oda Special Advisers wey follow na:

Mr. Yau Darazo- Special Adviser, Political and Intergovermental Affairs

Mrs. Olu Verheijen- Special Adviser,Energy

Mr. Zachaeus Adedeji- Special Adviser, Revenue

Mr. John Ugochukwu Uwajumogu- Special Adviser, Industry, Trade, and Investment

Dr(Mrs.) Salma Ibrahim Anas- Special Adviser, Health.

All dis appointments dey happen 17 days afta dem swear Tinubu as Presido.
Di Senate don approve di appointment of 20 Special Advisers for Presido on Tuesday 6th of June.

How una see di mata?
#chookmouth


 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 43°C | Low: 26°C