Super Eagles Skippo William Troost-Ekong Don Hang International Football Boot

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Super Eagles Skippo William Troost-Ekong, don talk say e no play again for di country, meaning say e don hang boot for international football mata.

Di 31-year-old defender drop dis update on Thursday for I'm social media page to take end im 10 years waka with Super Eagles, just as dem dey prepare to go fight for dia fourth Africa Cup of Nations (AFCON) trophy for Morocco.

Our Skippo talk say the 10 years wey e take play for Nigeria na di biggest privilege for im life. E write say, "Di waka don end here, but I no go ever stop to dey support di team."

E come thank everybody wey e don follow run tins for Super Eagles, including di oda players dem, and "The Big Boss", late Stephen Keshi, our coach wey give am chance to play for Nigeria in 2015.

Troost-Ekong play 83 times for Super Eagles and score seven goals. Everybody know am as strong defender wey get leadership spirit.

E follow Nigeria win bronze medal for 2016 Olympic Games for Rio and carry dem reach final for 2023 AFCON, where dem give am Player of the Tournament award.

Im last game for Nigeria na di World Cup playoff match against DR Congo last month. Even though e don komot hand for national team matter, e go continue to play for im club, Al-Kholood, for Saudi Arabia.

Di Nigeria Football Federation (NFF) and fans all over di country don hail Troost-Ekong for im hard work and service. Many people see am as role model for young players, to show wetin person fit achieve with hard work and love for im country.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 16°C