Seven Pipu, Plus One Pikin Don Die inside Lagos Bus Fire

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Na really sad Sunday as seven pipu naim dem sure say don die wen one commercial bus burn around Iyana Oworo area of Lagos State.

Five other pipu don suffer different burns for bodi.

Pipu wey die na four adult females, two adult males, and one male child.

Lagos State Environmental Health Management Unit (SEHMU) don carry dia dead bodi.

The Permanent Secretary of the Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) wey be Olufemi Oke-Osanyintolu tok say the motor catch fire becos of one electrical fault.


Kano Weather

  • Kano

    Light rain shower

    High: 42°C | Low: 25°C