Sanwo-Olu Don Collect him PVC and Him Dey Ginger Lagosians to Do Same

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Gov.Babajide Sanwo-olu of Lagos State dey beg citizens wey don reach the age of voting to go collect their Permanent Voters Cards, from the different Independent National Electoral Commission (INEC) offices wey near dem.

Sanwo-Olu talk dis one on Monday, when him branch INEC office for Sura area for Lagos Island Local Government Area to collect him own PVC.

People wey follow am go this journey na e Deputy Governor, Dr  Obafemi Hamzat, and some him cabinet members.


The governor wey want make them re-elect am for the platform of the All Progressives Congress (APC), some months ago change him location and update him details.

Him move him polling unit from Ikoyi to Lagos Island, in respect of di next year governorship election wey dey come.

Sanwo-Olu remind the people say na when dem collect their PVCs dem go fit use dia right as citizens to vote for the election wey dey come next year.


 ''Today, INEC don start to give people dia PVCs and na because I change my address of where I been dey and where I dey now, na why I move my polling unit.

  ''I come here to show all our citizens say I don do di needful. I don come collect my permanent and reprinted voters card and I want beg everybody to grab dis chance to go collect dia own PVCs.

''I don collect my own and as you can see say I dey INEC office here, and e dey very peaceful. Within two minutes, dem don arrange am and I sign to collect my own. So my advise for everybody wey never collect dia PVC na to come out come collect and do di needful.


''Na di only way wey you go fit vote for the next year elections. I wish all of us di very best as we join dis exercise, I hope say na something wey una go worth as another civic responsibility''. He talk.


 Sanwo-Olu talk with him full chest say him sure say di residents go do di right thing by re-electing/re-choosing am for di governorship poll, base on di work wey him don do for di first term.

''We go win becos we believe say Lagosians go do di right thing. And also because we believe say we don earn am; we don work very hard and we go continue to dey do am.


''We go continue to do our very best to make sure say we earn dia trust and di commitment of our people'', he talk.(NAN).
 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 20°C