Rukpokwu People Dey Cry Out As Big Water Don Cover Dia Community

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

As di flood don dey reach gbegbe levels, some residents don even begin comot from dia houses

Pipu for inside Rukpokwu area wey dey inside Rivers State don raise alarm as flood don dey enter dia domot, dey cause serious wahala for dem.

Dem don follow our talk talk pipu yarn say, di matter don become serious sai to say di bridge wey dem build for di area no dey allow water make e dey flow  again. Dem tok sai di bridge don block di canal wey di water dey normally pass before, and na eim dey make water dey spread enter di area wen rain dey fall.

As di flood don dey reach gbegbe levels, some residents don even begin comot from dia houses, as dem no fit cope again with di water wey dey enter dia compound and business places.

Business owners for di area too dey count dia losses, as di flood don make movement difficult and dey threaten dia daily hustle.

Di residents dey beg di Rivers State Government make dem no ignore di matter, but come inspect di bridge and find lasting solution to di problem.

Dem say government need to open up di blocked waterway and make sure say water fit flow like before, before di situation turn bigger wahala for Rukpokwu people.

Comments

Add a comment

Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 36°C | Low: 22°C