Rivers School Don Resume, Govment Go Post 5,000 Teachers

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Di man come beg students wey don return house make dem tell dia padi dem say school don resume...

Rivers state govment don tok say dem don begin dey fix and arrange public schools for different parts of di state, make students get better place wey dem fit learn well.

Di Education Commissioner, Dr Peters Nwagor, don waka go some schools to see how dem dey follow di resumption order. E tok say di work wey dem dey do for di schools na part of di govment plan to make school environment better for students and teachers.

Nwagor still tok say for di coming weeks, dem go post about five tousand teachers go different schools across di state, so teaching and learning fit dey move better.

Di man come beg students wey don return house make dem tell dia padi dem say school don resume, make dem no siddon house dey wait.

E also call on everybody make dem report any pikin wey still dey house even as school don start. According to am, teachers don ready well-well to welcome di students back.

Nwagor come beg parents make dem make sure say dia pikin no remain house now wey school don resume.

Comments

Add a comment

Kano Weather

  • Kano

    Thundery shower

    High: 34°C | Low: 24°C