
The Nigerian Association of Resident Doctors (NARD) don suspend dia five-day warning strike after Federal Government promise dem say dem go answer their demands.
NARD tok say di decision come after government show commitment to handle di wahala wey dem raise for dia strike communiqué and as payment don start for di 2025 Medical Residency Training Fund.
Dem announce di suspension inside statement wey President Dr. Tope Osundara, Secretary-General Dr. Odunbaku Oluwasola, and Publicity Secretary Dr. Amobi Omoha sign.
Di association explain say na dia National Executive Council resolve to suspend di action after emergency virtual meeting wey happen on Saturday, because of di condition of patients wey don already dey suffer inside economic wahala.
Di suspension go start from Sunday, and e give government two weeks chance to fulfill dia promise.
NARD still beg Oyo State Government make dem obey di 15-day ultimatum wey concern unresolved issues for LAUTECH Teaching Hospital, warn say if dem no gree, e fit lead to indefinite solidarity strike.
Dem still add say doctors wey dey work for state hospitals fit continue dia own local actions until government answer dia wahala.
Di doctors start di strike on September 12, and dia demand na better welfare, beta working condition, plus payment of arrears.
NARD tok finally say di suspension na just temporary, so Nigerians fit get healthcare while dem dey watch how government go respond.