Presido Tinubu and Sanusi Dey Inside Room Dey Talk.

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

President Bola Tinubu, on Thursday, bin get closed-door meeting with di 14th Emir of Kano and former Governor of the Central Bank of Nigeria (CBN), Sanusi Lamido Sanusi, for di State House.

Dis Sanusi visit na di first since Oga Presido enta office and dis one na almost one week afta di Presido suspend Godwin Emefiele as di CBN Governor.

Di agenda for di meeting, tokk tok pipo never still know.

Sanusi bin serve as CBN oga from June 2009 to June 2014 wen Emefiele come take ova.

On Friday, di Presido bin suspend Emefiele as Oga for CBN and direct di Deputy Governor of Operations, Folashodun Shonubi make he hold di office as acting CBN Governor.

On Saturday, di Department of State Services(DSS) confirm say Emefiele dey dia custody.

On Wednesday, Di CBN bin unite all di segments of di Forex market into one window.

How una see di mata?
#chookmouth 
 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 44°C | Low: 25°C