Presido No Approve Any Salary Increase - Alake

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Di Special Adviser Presido on Special Duties, Communications & Strategy, Dele Alake tok say President Bola Tinubu "neva approve any salary increase, and dat kind proposal neva reach him front for consideration."

For one statement on Thursday, Alake tok say e dey for constitution for di Revenue Mobilistion, Allocation and Fiscal Commission to propose and fix salaries and allowances for pipo wey dey political office and Judicial officers. 

He still tok say even though dat one dey constitution, presido need to approve am. 

Di Presido spokesman still tok say di Revenue Mobilisation, Allocation and Fiscal Commission join bodi tok say dat tori wey come out say na fake. 

Remember say on Wednesday, tori come out say 114% increase don dey on top salary of Presido, Vice Presido, and oda Federal and State political office holders and judicial officers 

How una see di mata?
#chookmouth

  


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 44°C | Low: 25°C