Presido Don Tell EFCC Oga Bawa Make Eim Commot For Office

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Nigerian Presido Bola Tinubu don tell the Chairman of the Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) Abdulrasheed Bawa, make eim commot for eim office for now until dem finsh to dey chook eye on top the case wey dem put for eim head.

Na the director of information, for inside the office of the Secretary to the Government of the Federation Willie Bassey naim tok this one for the presido.

Eim tok say oga AbdulRasheed Bawa, CON, get mata wey dem dey chook eye ontop if eim do anyhow with the power wey eim get as EFCC oga. Dem don tell am make commot for the office for now until wey dem go finish the case, also make the Director, Operations of EFCC dey do eim work.

If you remember say for may, Oga Bawa send message to all the governor's wey dey commot for office, say EFCC go start to dey chook eye on top the things wey dem and their commissioners do when dem dey office.

The message no sweet some governors for belle at all, even former Zamfara state governor Bello Matawalle, tok say make Bawa commot for office as EFCC chairmo because eim dey using eim power anyhow.

Now the question wey many pipu dey ask na, shey na corruption dey fight EFCC Oga Bawa back? Na only time go tell.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 44°C | Low: 25°C