Presido Don Rename Airports Afta Buhari,Usman Dan,Awolowo And Many Others.

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Presido Bola Tinubu don rename some federal airports afta many ogbonge pepo dem.

Na di Federal Ministry of Aviation com out tok dis mata say, dem understand why Presido be rename some airport say na part of reforms of di aviation sector.

Di Maiduguri Airport, Presido rename am afta di former presido wey be Muhammadu Buhari and di Port Harcourt say dem rename am afta di late nationalist Obafemi Awolowo.


Di Nasarawa Airport dem rename am afta di late founder of sokoto Caliphate,Usman Dan Fodio and di Benin Airport afta di late oba of Benin, Oba Akenzua II.

Di Ibadan Airport dem rename am afta di late Premier of di old Western Region, Ladoke Akintola.


How una see dis mata??
#Chookmouth
 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 43°C | Low: 26°C