Pope Leo Dey Pray For People Wey Die For Benue Killing, E Still Beg Make Peace Reign For Sudan.

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Pope Leo don talk say e dey sorry and e stand gidigba with the victims and families of the about 200 people wey dem kill for the terrible massacre wey happen for Benue State.

For him Sunday talk, Pope Leo condemn the violent wahala wey shele for Guma and Yelwata, and e beg the international community make dem join body dey pray for the people wey the thing affect for Benue State. E talk say na peace and healing the region need pass now.

The Pope come talk say e important make dem tackle wetin dey cause all this kind violence from the root, and e beg leaders for Nigeria and abroad make dem work together find better solution wey go bring peace and safety.

No be only Nigeria e pray for , Pope Leo still carry him mind reach Sudan, wey still dey face serious gbege.

E beg make everybody wey dey involved for the Sudan matter try follow talk and settle the wahala with peace, instead of fight. E say make dem work together so better cooperation fit dey.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C