Police Rescue Woman Wey Kidnappers Carry For Eleme, Grab One Of Di Boys

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Di boys fire gun for air before dem force Loveth enter motor and carry am waka.

Rivers State Police don rescue one woman wey kidnappers carry for Eleme, and dem don also grab one man wey dem suspect say na part of di boys wey dey do kidnapping.

Di woman, wey dem call Loveth, dey sit for front of her shop on September 2 when di kidnappers show face.

Di boys fire gun for air before dem force Loveth enter motor and carry am waka.

Police PPRO, ASP Blessing Agabe, tok say as police hear wetin happen, boys from Eleme Police Division begin gather information on di kidnappers and start to find where dem dey.

She tok say police later meet di kidnappers for road and gun battle start between dem. Na during di fight police take rescue Loveth.

Police also grab one 35-year-old man wey dem call Victor Ini. Dem suspect say na him be one of di boys wey dey inside di kidnapping gang.

Police say dem still dey dig into di matter, as dem dey find di other boys wey join hand for di kidnapping. Dem say dem no go rest until dem grab everybody wey get hand for di matter.

Comments

Add a comment

Kano Weather

  • Kano

    Thundery shower

    High: 34°C | Low: 24°C