Police Inspector Wife Beg UPTH Make Dem Do Her Husband Third Operation Sharp-Sharp

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

She also talk say the family don dey face serious financial wahala...

The wife of Police Inspector wey sustain gunshot injury during attack on police checkpoint for Mbodo-Aluu axis of Obiri Ikwerre, Ikwerre Local Government Area, Inspector Godday Aleru, don beg management of University of Port Harcourt Teaching Hospital make dem quickly do her husband third operation.

Cecilia Aleru make the appeal during interview with our correspondent, Emeka Ortuka. She talk say her husband dey pass through serious pain now and e urgently need the operation.

She also talk say the family don dey face serious financial wahala because the money wey dem dey spend for her husband treatment don too much.

Cecilia come appeal to well-meaning Nigerians, companies and philanthropists make dem support the family with money, so Inspector Godday Aleru fit continue to get the medical care wey e urgently need.

Comments

Add a comment

Kano Weather

  • Kano

    Heavy rain shower

    High: 32°C | Low: 22°C