Police Don Rescue Di ASP Wey Dem Kidnap For Kwara

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Di Police Command for Kwara don confam say ASP Ahmed Yusuf don dey safe from di hand of kidnapper inside bush wey dey betwwen Kwara and Oyo State.

According to di tori,six men wey carry gun na dem enter di ASP house for Ilorin for Oct.11 go kidnap am.
Di toktok person for the Police Command wey be SP Okasanmi Ajayi na eim confam say vigilante,hunter and di Oyo state Amotekun Squad na dem join bodi with di Police to take rescue oga ASP.
As e be like dis,di ASP dey under medical checkup before dem go allow am to meet eim family.

 

How U See D Mata ?? #chookmouth 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 20°C