Police Don Arrest Di Man Wey Tweet 'Let's Kill All The Igbos'

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Police for Osun State don arrest 28-year-old Kehinde Adesogba Adekusibe wey violate di hate speech policy on social media.

Di arrest follow afta one tweet wey di suspect post onMay 18, 2023, where he for tok some kind bad tins against di Igbo ethnic group.

Di tweet bin read "Let's kill all the Igos. Let's flush them out of Yoruba lands. I hate these people with passion. They are violent people. They are the worst. They hate us. Let's hate them without holding back." 

One statement from Osun Police tok say as dem receive di report, dem start investigation wey make dem come arrest di suspect for Ilesa, where him bin dey hide.

Wen Police dey ask Kehinde Adekusibe serious questions, him come confess say him tweet am and now investigation go continue before dem carry am go court. 

How una see di mata
#chookmouth 


 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 44°C | Low: 25°C