On Air Now

Evening Oyoyo

8:00pm - Midnight

Police Dey Tell Pipu Wey Sabi Prank Pipu To Dey Careful With Dia Pranks

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

The Nigerian Police Force want make pipu wey sabi prank pipu to dey careful with dia pranks becos "Pranks don dey put pipu for wahala"

Police don warn say some pranks "don dey pass be careful"

Di Force Public Relations Officer wey be Muyiwa Adejobi, tok dis one inside video wey him share with journalists. 

Di police spokesman, really, warn social media pipu wey dey use guns inside dia skits to prank, him say make dem stop am oh!

Him say officers fit mistake dem for criminals wey carry real guns.

Him also yarn say, as e be now, police fit dey forced to stop some of dis pipu wey sabi prank.

“we fit try to manage anything wey we dey do?, we no fit say make una no do una business, but dis prank don dey plenty evri where and e done also dey deangerous"  na wetin him tok.

"No Management, una dey do as una like and e dey cause more problems for us dan di fun una think say una dey get from di pranks." 

"Abeg make we manage am or stop to create pranks?" na wetin him ask for the Video.

Adejobi also say Pipu wey sabi prank dey risk dia lives and oda pipu lives. 

 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 43°C | Low: 24°C