PDP Presidential Primary: Wike Don Ask Court to make am Winner

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Governor Nyesom Wike of Rivers State don sue the presidential candidate of the Peoples Democratic Party, Atiku Abubakar; the Sokoto State Governor, Aminu Tambuwal; even the PDP over the PDP’s presidential primary.

Mr. Atiku use 134 votes take pass Gov. Wike for the primary wey happen for Abuja on May 28 and May 29.

Na becos Gov. Tambuwal withdraw from the presidential race for the venue of the primary, plus him tell him supporters to vote for Mr. Atiku naim make Mr. Atiku’s win am.

But Gov. Wike don file suit, him dey ask Court make dem chookmouth tell am weda the transfer of Tambuwal vote to Atiku by PDP dey Legal.

Newgent Ekamon wey also be member of PDP/co-plantiff follow join the case with the Governor of Rivers.

Dey want make court cancel Tambuwal vote wey dem transfer give Atiku.

Dey also want court order wey go stop Tambuwal to withdrawfrom the primary since "E happen after voting" 

Dey also want make the court order INEC to reject or remove Atiku from the list of candidates for the 2023 presidential election and anoda order wey go make PDP to recount the votes of the primary.

The duo also want make the court tell PDP to declare Wike as the winner of the primary.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 20°C