Oga for AIT, Dokpesi Don Die at 71

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Di Founder of DAAR Communications Plc, High Chief(Dr.)Raymond Dokpesi don die.

He die on Monday 29 May according to di statement wey eim son Raymond Dokpesi (Jnr.) sign for di family.

High chief dokpesi wey be husband, papa, grand father and friend to many and all di people wey know am go miss am well well.

Him bin di High Chief Raymond Aleogho Anthony Dokpesi (Ezomo of Weppa-Wanno Kingdom) and  corect buisnessman for media industry. Na him be the man wey get Africa Independent Television(AIT)and radio station, Ray Power FM.

High Chief Dokpesi bin dey 71 years wen him die. Him bin correct friend of Atiku Abubakar, wey be PDP presidential candidate for di 2023 General Election.

Him family do release him funeral arrangements soon.   


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 21°C